>PSALM 23! pidgin version BY
fran6 ..
1. The Lord na my shepherd, I
dey kampe. 2. E make me sidon
for where better dey flow and
come put me next to stream
make my body thermocool. 3. E
panel beat my soul come spray
am white, come dey lead me dey
go through express road of
righteousness because of Hin
name. 4. Walaii! If I waka pass
where arm robber, 419 and juju
people boku, come even join
boko haram reach valley of the
shadow of death sef, liver no go
fail me. Your rod and staff nko?
Na so dem dey like backbone dey
comfort me. 5. You don arrange
good food on top table make I
chop. See bad belle people dey
look waa waa. You rub me for
head with vaseline intensive
lotion. My cup come be like River
Niger dey troway dey go. 6. True
true, better life and mercy go dey
follow me till I quench. And I go
tanda for God house... lai lai I no
go comot for wia better dey. God
Almighty, Na you biko! AMEN
make my body thermocool. 3. E
panel beat my soul come spray
am white, come dey lead me dey
go through express road of
righteousness because of Hin
name. 4. Walaii! If I waka pass
where arm robber, 419 and juju
people boku, come even join
boko haram reach valley of the
shadow of death sef, liver no go
fail me. Your rod and staff nko?
Na so dem dey like backbone dey
comfort me. 5. You don arrange
good food on top table make I
chop. See bad belle people dey
look waa waa. You rub me for
head with vaseline intensive
lotion. My cup come be like River
Niger dey troway dey go. 6. True
true, better life and mercy go dey
follow me till I quench. And I go
tanda for God house... lai lai I no
go comot for wia better dey. God
Almighty, Na you biko! AMEN
No comments:
Post a Comment